E dey contain anything wey you won sabi
for this Aza
E dey contain anything wey you won sabi for this Aza
E dey contain anything wey you won sabi
for this Aza
E dey contain anything wey you won sabi for this Aza
Make una hear wetin Mr CEO won yarn
Make una hear wetin Mr CEO won yarn
Your funds go dey safe hands, no be all those ones wey den go thief am den company go won compensate you.
We no dey charge much for Aza, in fact most things wey you go do no even get charge at all, if at all we don try na.
Our technology dey make sure say money wey you transfer dey move like thunder, no wasting time.
You no fit hear stories say you dey try send money and ee no dey work abi money never reach where ee suppose go.
If at all we try for our design na. Omo Forget, Aza app just fine die!
Aza no get corner corner, everything dey straightforward. You no go see all those annoying things wey no concern you.
Your funds go dey safe hands, no be all those ones wey den go thief am den company go won compensate you.
We no dey charge much for Aza, in fact most things wey you go do no even get charge at all, if at all we don try na.
Our technology dey make sure say money wey you transfer dey move like thunder, no wasting time.
You no fit hear stories say you dey try send money and ee no dey work abi money never reach where ee suppose go.
If at all we try for our design na. Omo Forget, Aza app just fine die!
Aza no get corner corner, everything dey straightforward. You no go see all those annoying things wey no concern you.
To transfer money between Aza users dey free. Ee go only cost N10 make you transfer money to other banks and N50 make you credit your Aza account with your Debit card, and you fit only deposit N200 and above if you use your Debit card. But make una know say every other transaction una go do on top Aza dey free, like to dey pay bills den tinz. We go update una on how the cost go be for our new features very soon.
Aza get 4 account tiers. Tier 0 na for new people wey register for Aza, this tier no fit allow user do any transaction. After the new user don verify their BVN, then go enter Tier 1, this go allow them transact only N50,000 daily and highest wey den fit store for the account na N200,000. Users fit enter Tier 2 if den verify their Identity (NIN card, International Passport, University ID, Driver’s license or Voters Card) for Aza, this go allow them transact N1,000,000 daily and highest wey den fit store for the account na N5,000,000. If person won enjoy Aza wella wella, na to verify their Proof of Residence (Utility Bill, Bank Statement etc)so Say den go enter Tier 3, this go allow them transact up to N10,000,000 daily and no limit to how much den fit store for the account.
As we dey talk to you now, we dey try secure all the licenses wey we go need from CBN so that we no go get any problem with CBN.
Aza dey use latest security technologies to protect your funds. In fact we dey even store your data for Apple keychain and Android Keystore so say we no fit even access am, ee mean say your privacy dey protected. We dey also sanitize your inputs to see weda anything dey abnormal and to prevent SQL injections. We con dey time our biometrics confirmation requests to make sure say person wey dey currently use the account na am get the account. All requests go dey in Https and for SSL to make sure things dey more efficient. We dey also use some blockchain innovations like decentralization so say data go dey more distributed and hard to hack. So all these ones now dey make sure person wey dey try hack Aza just dey waste hin time.
Aza don adopt “No Poverty” SDG. Ee mean say Aza go help comot Sapa for Naija. In fact, we don pledge to donate 5% of our quarterly profits to plenty charities and NGO’s wey dey Naija. Ee also get way wey you fit help us for this our mission, na to go the Aza app den make you select any charity wey you dey believe, den you fit donate any amount wey you want. We dey take this SDG very serious coz say Poverty na our number 1 problem for Naija and we go like see every Nigerian dey enjoy their lives (Soft Life).
This na policy wey Aza don adopt to make sure say we dey communicate our Progress, Negative &Positive Updates to all of una (Azarians) coz say we won mey trust dey between the Aza family, and if trust go dey ee means say we no fit dey hide anything from una.
This na one beautiful seal wey una go dey see for all Aza physical products, ee dey mean say that product na original and ee come from us directly. The seal get the signature of the CEO himself (Mr Aleemz)
Den get high chance say we go release update for Aza wey go allow people mey den invest for Stocks and Crypto so say den go begin their investment journey, and as una knowhow Aza be una go sabi say ee go dey very easy to use and una assets go dey safe.
As we dey talk to you now, we dey work on releasing our Virtual Aza Card wey go allow una buy or subscribe for any product or service, for both app and website. We go dey update una on how ee dey be for our Social Media.
Aza POS feature go allow POS Merchants to dey make steady money from commissions wey den go dey get as den dey give out cash. Aza POS feature better pass other POS businesses coz say for this one, merchants no gas even buy POS Machine or use Debit Card, everything dey happen on top the Aza App. No need to dey join long queues for Atm machines, Aza POS dey here for you. We go update una on when we dey release this feature and how exactly ee go operate.
Aza vault dey help you lockup funds wey you no want touch for any time frame you choose . But as we sabi say sometimes you fit need the money wey you lock for something urgent, we don make way wey you fit unlock the money. Na to just email us your issue for the Contact us section wey dey the Aza app, and one of our Customer agents go call you to explain how you go fit unlock your money. We do am like this so say mey hackers no try impersonate you try unlock your Vault funds.